I CANCEL THE WORD 'FRENEMY'!!!!! Hisssssssss.

[Pidgin English Write-up, no translation, ma bad...]

OK, OFFICIALLY, I CANCEL THE WORD FRENEMY FROM MY VOCABULARY!!! THERE IS NOTHING LIKE FREMENY O JARE!!!
  • PERSON NA EITHER YA FRIEND OR YA ENEMY!!!
  • OR THE PERSON USED TO BE YOUR FRIEND AND DEVIL ENTER AM TO USE AM TORMENT YOU AND HIN SELF NO KNOW! SO, HIN GO BE JUST ENEMY AT THAT POINT KWA!
  • OR PERSON FIT JUST BE DEVIL PERMANENT SECRETARY AND NO GET REMEDY!! HIN OWN WORK FOR THIS EARTH NA JUST TO TORMENT PEOPLE!! SO, HIN NA ENEMY! Gbam!
  • OR PERSON BE YA FRIEND AND UNA JUST FALL OUT AND UNA GO STILL FIT RECONCILE LATER, AFTERALL NO TWO TRUE FRIENDS REMAIN ENEMY FOR LIFE. AND SOMETIME CONFLICT IS NECESSARY!
  • OR PERSON JUST BE YA FRIEND, HIN FIT HATE YOU, HIN FIT ENVY YOU, BUT IN A HEALTHY WAY COS HIN GO DEY ASPIRE TO BE LIKE YOU AND NO GO DO YOU NO HARM OR MEAN YOU ANY HARM!
  • OR......HMMMM.....SOME PEOPLE ARE JUST THE DEVIL HIMSELF/HERSELF!!! :

So dia fore, nothing like FRENEMY for ma vocab anymore!

Friendship sef get expiry date! Shuo! When E end, E suppose just end with everyone going their seperate ways PEACEFULLY (I hope and pray!!!) And NOT scheming to hurt people wey no do ya nathing!!!

I was 'almost', I mean, just a tiny bit annoyed that a clown that developed teeth overnight to bite me postponed his own shame lying to postpone his shame! But, I wait.... I patiently wait.........yes O! I wait! Because my father in heaven will exonerate and vindicate me come next january!!! I wish the whole ish closed out today, but, music wey person play, na hin, him go dance!I be yanga wey be the sleep, trouble come wake me up, and I still beg trouble to leave me alone O! Trouble begin bite, pinch and punch me, I still dey look trouble like mumu, and trouble still refuse to stop to wahala me! OK, now, Chineke wey dey for Eligwe naw don scatter all trouble plans around me, and trouble begin run! Hin shadow don dey chase am!!!

I truly and honestly feel sorry for trouble! because I don talk am say some people no dey know wetin dem dey do sometimes, when devil begin use them to attack God childrens! Like today one other person wey been suppose be friend wey been turn to devil overnight curse me eh, curse me eh! threaten me O, and hala me O! Na hin turn around to apologize say hin dey sorry, hin be dey "under so much pressure then". OK, I forgive am, but tell am to just lerrus keep it on the main road greetings! Make hin no dey call me again......hin say I dey still vex,! I tell am say if I dey vex, I for no dey even pick hin call.....Say I understand, afterall, I be God pickin!

I been don tell God to give me a FREE PASS for just one day to deal with certain people drastically and in the earthly way! YES!!! TO SHOW THEM PEPPER!!! I GO PRAY ONE WEEK AFTER AND FAST TOO FOR ATONEMENT! Haba!!! And God for whisper to my ears say Jesus no even utter one word when hin people dey kill am! Hin no even vex with Judas, hin no vent for Peter, and hin no blind or throw thunder on the soldiers wey dey beat am and all, hin just go the slaughter like a lamb! Ok, God come ask me , WHAT DID JESUS DO (WDJD), I come tell God say, I no be Jesus naw! Hin come remind me say Jesus been don leave hin peace for me on earth here.... and ability to forgive! I don ask this question before, and E dey bite me baaad now!!

WHAT DO YOU DO WHEN YOU HAVE EVIDENCE THAT SOMEONE THAT HAS BEEN TRYING TO MESS YOU UP CAN GO TO JAIL FOR SOMETHING THEY DID TO YOU!!! AND SOMETHING THEY ALSO DID BEFORE?!!! WOULD YOU GLADLY HAND THEM OVER TO THE POLICE? KNOWING THEY CAN GO TO JAIL FOR IT!!? I really got to know! At what point do you NOT just let things be?

Comments